SMAN , incase you are looking forward to getting this identity card

Stingy Men Association of Nigeria: SMAN App, ID Card plus oda 'tins' wey spring out sake of dis trend

Stingy Men Association of Nigeria (SMAN) don enta anoda level as App don dey for men wey dey stingy and no dey ready to spend dia money on any woman.

Aside from di App wen don dey play store, oda groups don begin spring up sake of am.

Di Stingy Men Association of Nigeria first start as fun afta singer and producer, Don Jazzy tweet im own ID card and write say 'Registration complete'. Inside di tweet wey get more than 11,000 retweet, Don Jazzy write for im ID card say e be Head of di union.

More Nigerian celebs like Paul Okoye of former Psquare, Mr Eazi and some odas don dey use di trend to catch cruise. Even female celeb like Toke Makinwa also catch cruise for dis mata too.


But e be like say some Nigeria don begin take dis mata serious sotey dem don create App wia di so called 'members go take arrange dia identity card.

Copy and click the link below to read more

https://www.bbc.com/pidgin/tori-55637250

(Also follow SMAN on Twitter, https://twitter.com/SMANofficiaI/status/1348598732925919233?s=19)

You can download and place your picture,

Post a Comment

0 Comments